Wahala happen for Awka, Anambra State, as one small masquerade pikin die after one keke (commercial tricycle) jam am for Imo Awka festival wey happen on Sunday, May 11.
Di sad incident happen as plenty masquerades and people full di street dey celebrate di yearly Imo Awka festival. According to wetin eyewitnesses talk, di masquerade na just small boy wey wear masquerade costume. One keke wey dey pass mistakenly jam di boy and crush him skull.
People wey see am say di accident happen suddenly and e shock everybody. Dem still dey try arrange things after di tragedy spoil di mood of di celebration.
look down make you see how e take happen oooo......chai...
