Fighting and aguement no good ooo see Wahala…..Person don kpai ontop fight

Fighting and aguement no good ooo see Wahala…..Person don kpai ontop fight

One 46-year-old man wey dem dey call Philip Ogbuehi don enter police hand because of how one man kpai after dem drag road matter for one lounge wey dey Ogidan Sangotedo area for Lagos.

According to wetin Lagos State Police Command talk, di kasala happen on May 6, 2025, around 8pm, as Ogbuehi and di man wey later kpai begin exchange hot words.

Na so Ogbuehi give di man one serious blow for chest, and di guy just fall lose consciousness.

Dem rush am go hospital sharp-sharp, but doctor later confirm say di man don die.

Police say dem still dey investigate di matter, and dem never release di name of di person wey die.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *