Wahala for Ikorodu: 19-Year-Old Girl kpai Herself Because of UTME Score
Ikorodu, Lagos – One 19-year-old girl wey dem dey call Timilehin Faith Opesusi don throw her family inside big sorrow as she take her own life because she no happy with the score wey she get for 2025 JAMB exam (UTME).
Dem talk say the girl drink rat poison after she see say she score 190, and the thing pain her well because she do better for the 2024 exam before.
This sad matter happen for Odogunyan area of Ikorodu, Lagos, on Monday, May 12, 2025. Timilehin dey stay with her senior sister for that area.
According to The Guardian, she bin apply to study Microbiology. One of her close friends talk say:
"She talk say her last year result better pass this one."
Na for her sister office she ask for red oil after she begin feel pain from wetin she don drink for house. As her sister notice say something no right, she raise alarm, and people rush come help.
As dem dey rush go hospital, Timilehin confess say na poison she drink because of her UTME score. Sadly, she later die for Kolak Hospital, still for Odogunyan.
watin shoch people come bsay, She come Get Admission 30 Minutes After She Die....Kia e too sad o
Wetin pain pass be say, 30 minutes after dem pronounce her dead, one admission message enter her Gmail. Dem give her provisional admission.
One family member yarn say:
"The most shocking thing be say na after dem talk say she don die for Kolak Hospital, na that same time admission mail enter her Gmail."
Her mama and papa rush come from outside Lagos when dem hear the tori. Dem carry her body go Abeokuta, Ogun State for burial
Life still dey. Your story never finish. No matter how e be, better fit still show. If you dey feel hopeless, abeg try talk to somebody or find help. Life na one step at a time.
