Super Eagles and Nottingham Forest striker, Taiwo Awoniyi, dey coma after dem do emergency surgery for serious belle injury
Super Eagles striker, Taiwo Awoniyi, wey dey play for Nottingham Forest, dey inside induced coma and dem dey give am serious treatment after emergency surgery for one correct abdominal injury.
Di 27-year-old Nigerian international knack him body for post during their 2-2 match against Leicester on Sunday. Even after dem treat am for few minutes, e still try play but later dem carry am commot.
On Tuesday, May 13, Forest come confirm say dem rush am go hospital and doctors do emergency surgery after dem confirm how serious di injury be on Monday.
Di surgery na complex one, but according to Mail Sport, di early signs show say di operation go well. Doctors bin dey expect say dem go finish everything that same day.
Dis kind injury fit even kill person for some kind cases, but Forest talk say Awoniyi dey recover well.
But wahala burst as di club come blame their own medical team.
Dem say dem no fit substitute Awoniyi because dem don use their last sub when dem replace Elliot Anderson with Jota Silva. Di striker try continue play but e no fit move well again, even as Forest dey chase late goal wey fit help their Champions League hope.
As Forest play last few minutes with only 10 players, na there e be like say di club owner, Evangelos Marinakis, vex for coach Nuno Espirito Santo for full-time.
Later, Forest release one statement to talk wetin really happen:
"Taiwo Awoniyi injury na big reminder say football no be small thing, and say player health suppose come first. Our owner, Evangelos Marinakis, no just dey see Forest as club — na family to am. E dey carry di message give everybody for club.
Na why di matter touch am wella. E no be say na just normal injury — di thing touch everybody for heart.
When him see say Awoniyi no dey okay, e no fit just siddon look. Na human reaction. Na show say di players mean plenty to am.
E no fight with Nuno or anybody, whether for field or inside stadium. Na just frustration wey everybody dey feel say di medical team no suppose allow am play again.
So, we dey beg people — ex-players, ex-coaches and people for football — make una no rush go post fake news or judge without knowing wetin really happen.”

