Nigerian President don chop win oo as the Latest Pope don invite am to come for him inauguration party…

Nigerian President don chop win oo as the Latest Pope don invite am to come for him inauguration party…


Pope Leo XIV don invite President Tinubu go Rome, Italy, make e attend im inauguration wey go shele on Sunday, May 18.

Di ceremony go mark di beginning of Pope Leo XIV reign as di 267th Bishop of Rome, and e go happen for St. Peter’s Square inside Vatican.

For di invitation wey dem send to Nigeria president, Cardinal Pietro Parolin, on behalf of Pope Leo XIV, talk say Tinubu presence for di event dey important well-well for Catholic Church, especially as di world dey face plenty wahala and gbege.

For statement wey come out on Thursday, Bayo Onanuga, wey be di president’s spokesperson, talk say di visit show say Nigeria and Vatican get better diplomatic relationship.

Di Pope talk say, “Your great nation dey very close to my heart as I bin work for Apostolic Nunciature for Lagos during di 1980s.”

President Tinubu go waka with Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Bianca Odumegwu-Ojukwu, Archbishop of Owerri and President of Catholic Bishops’ Conference of Nigeria, Archbishop Lucius Ugorji, Archbishop Ignatius Kaigama of Abuja, and Alfred Martins of Lagos.

Di Catholic Bishop of Sokoto Diocese, Mathew Hassan Kukah, sef go follow for di president team.

Pope Leo XIV, wey dem know before as Cardinal Robert Francis Prevost, go officially take position on Sunday, May 18, for St. Peter’s Square for Vatican.

Na di Conclave of Cardinals vote for am 27 days after Pope Francis die on April 21.

President Tinubu go come back to Abuja on Tuesday, May 20.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *