Murderer..from our fellow amebor countable, we dey hear say one man don kill em ex- girlfriend o when her marriage don near..see the story for down

Murderer..from our fellow amebor countable, we dey hear say one man don kill em ex- girlfriend o when her marriage don near..see the story for down

One man wey dem identify as Ogbonna, wey people sabi as Mourinho, don allegedly k!ll im former girlfriend, Chisom Ayogu, for im house wey dey Nsukka Local Government Area for Enugu State.

Di girl wey die na from Amufie community for Igbo-Eze North LGA for di same Enugu State. She waka go meet Mourinho for im house wey dey New Anglican Road, Nsukka, to tell am say she wan marry soon, na wetin Vanguard talk be that.

But as she reach there, na so Mourinho begin beat am. When people come show face to help, dem see say Chisom don already faint. Dem rush am go hospital but doctors talk say she don already d!e before she reach.

Police don arrest di suspect, Ogbonna, wey be from Igogoro community for Igbo-Eze North LGA, and dem don carry am go for questioning.

e no concern us but na there we want chuk mouth make una know the full gist.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *