man United don set to sign matheus cunha for 62.5m

man United don set to sign matheus cunha for 62.5m


Manchester United dey almost complete di signing of Matheus Cunha from Wolves.

Mail Sport bin report for April say United don almost reach agreement with di Brazilian player before dem go activate im £62.5 million release clause for Wolves.

United dey expected to trigger di £62.5m release clause wey dey im contract.

According to UOL, Cunha dey near to sign im United contract, as di club still get small financial space ahead of summer.

Di forward wey dem sign from Atletico Madrid for 2022 with fee wey near £34m, don score 27 goals and give 13 assists for 63 Premier League games.

Dem ask Amorim about Cunha last month, e talk say:
“I no go talk anything about Matheus, because if I talk once, I go gats dey talk for every situation – whether na yes or no.”
“I no go comment for dat one. E hard to predict wetin fit happen for future.”


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *