Di Nigerians in Diaspora Commission (NiDCOM) don receive another group of 13 Nigerians wey dem traffic go Ghana and Mali. Na 12 girls and one five-year-old boy dey among di returnees. Di NiDCOM Chairmo, Abike Dabiri-Erewa, welcome dem, according to wetin di Director of Media, Public Relations and Protocols Unit, Abdur-Rahman Balogun talk for one statement wey dem release on Sunday.
Di victims talk say na lie dem take carry dem go, promise dem say better work dey wait for dem, but later dem force dem enter ashawo work. Di girls talk say dem suffer well-well — from sexual abuse, beating, and emotional wahala from di traffickers for both Ghana and Mali.
Dabiri-Erewa tell di returnees say NiDCOM go support dem to settle back for society. She promise say di Commission go give dem all di help dem need to go meet their families and go also work with di governors of di states wey dem from to make sure say dem fit get proper rehabilitation.
She still talk say e dey important make government fight human trafficking serious. She say anybody wey dem catch and convict, dem suppose call dem name and shame dem, to help stop dis kain modern slavery wey dey spread for Nigeria.

