Rihanna bin shine well well for Cannes Film Festival 2025 red carpet. Di singer rock one bright blue halter dress wey dey give serious Smurfette vibes — especially as she don voice the popular cartoon character for the new “Smurfs” film wey go soon drop. Di gown open small so pipo fit see her baby bump.
Rihanna show her belle for Cannes Film Festival 2025 red carpet (photos)
Her longtime boyfriend, A$AP Rocky, follow her go the event and him wear suit. Di rapper help Rihanna waka come down stairs and him even hold umbrella cover her from rain.
Di couple wey dey expect pikin still hold body do small PDA while dem pose for camera.




