APC governors don agree say na only President Bola Ahmed Tinubu go run for president under APC come 2027.
Di Progressive Governors Forum (PGF) officially endorse Tinubu as di only APC candidate for di 2027 presidential election.
Governor Hope Uzodimma of Imo State, wey be di chairman of di forum, announce am during APC summit wey happen on Thursday, May 22, for Abuja.
As e dey talk on behalf of all APC governors, Uzodimma talk say dem believe say Tinubu leadership dey very important for Nigeria to move forward. “For Nigeria to reach her destination quick and enjoy better life, na the president suppose continue. So make we adopt am as our candidate for 2027, to run second term,” na so Uzodimma take talk.
Governor Uba Sani of Kaduna State come second di motion. E talk say e believe well well for Tinubu leadership and go give full support. “I stand gidigba to support the motion wey the chairman of Progressive Governors Forum — Governor Hope Uzodimma — don move. Make this important gathering give vote of confidence to our correct and capable president, Bola Ahmed Tinubu, as APC only candidate for 2027 general election,” na wetin Uba Sani yarn be that.
This endorsement come after APC governors from north-central zone don already pass vote of confidence for Tinubu government on Wednesday, May 21.

