FB dey make 52 Kobo from every N1 wey dem dey generate from dangote cement company full story dey down o

FB dey make 52 Kobo from every N1 wey dem dey generate from dangote cement company full story dey down o


Aliko Dangote, wey be the founder and oga of Dangote Group, don reveal say the Nigerian federal government dey collect 52 kobo as revenue from every one naira wey dem generate from the production and selling of Dangote Cement. The big business man yarn dis one when e dey talk for the 2025 Taraba International Investment Summit wey happen on Wednesday, May 21.

For him speech, Dangote talk say tax dey play serious role for how country dey grow, and say the money wey government dey get from private businesses dey help dem provide important services for the people. “I sure say e go shock una to know say na federal government of Nigeria — no be even state — dey make more money from, for example, our cement business. For every N1 we make, 52 kobo dey go government hand,” na wetin Dangote talk be that.

Dangote still talk say e better make government focus on creating better environment for businesses instead of say dem wan dey run business by themselves. “We dey always talk say government no get business for inside business. If na true, make dem comot hand from business. But then, how dem go take make money, send people go school, build hospital, road and other better infrastructure? Na wetin? Na tax,” na so e talk am.

E come use America take do example. Dangote talk say even though America na the biggest oil producer for the world, their government no dey own oil block. “You don ever hear say American government get oil block? No, dem no get. But dem still be the biggest oil producers for the world today. How dem dey make money? Na through tax,” e add.

Dangote still talk say e important make government support Nigerian investors well well so foreign investors go wan come. According to am, foreign investors dey like enter market wey local businesses don already dey do well. E still promise say Dangote Group go continue to invest for Nigeria, provide work for people, and help local communities grow.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *