One actress don talk on how to maintain good shape and na what dey make her look sweet 16.. Tory dey down..

One actress don talk on how to maintain good shape and na what dey make her look sweet 16.. Tory dey down..

74-year-old British actress Jane Seymour tok say di secret to her fine body wey no dey show age no be strict diet or weight loss medicine like Ozempic—but na just simple and steady way of chop.

According to Daily Mail, di former Bond girl talk say she don dey maintain di same body size since she be teenager, all thanks to di Mediterranean style of food. Every day, her routine be like this:

– She dey drink coffee and chop boiled eggs for morning to get protein
– Her main food dey come around 1:30pm, mostly fish and vegetables
– She dey chop greens wey she grow for her backyard
– For snack, she dey go for healthy tins like pistachios, cucumber, celery, and hummus

She talk say she no believe for all dis “I dey on diet” lifestyle. “If you dey feel say you dey on diet, you go lose focus. But if you find better healthy food wey you like, you no go ever feel say you dey miss anything,” she yarn.

To keep her body fit, Seymour dey lift small weights and dey do Pilates.
“You gats dey move body!” she add.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *