President Bola Tinubu talk say e dey expect more politicians go waka join di ruling All Progressives Congress (APC) before 2027 general elections.
E talk dis one on Thursday, May 22, for APC Renewed Hope Agenda Summit wey dem do for State House Conference Centre.
As im spokesman, Bayo Onanuga, take talk, di President yarn say e happy with wetin him government and APC don achieve so far, and say e no understand why person go still dey inside “sinking ship wey no get life jacket.”
E talk say:
“One-party system no too good for democracy, but na APC dey rule and we dey carry di hope of Nigerians go front. You no fit expect people to still dey for ship wey dey sink. I dey happy with wetin we don do, and I dey expect more people go join – na so politics be.”
Tinubu also tell party leaders, APC National Working Committee, National Assembly leaders, and di 22 Progressive Governors say di economic reforms wey him government dey do don dey get better recognition from people both for Naija and abroad.
E come talk:
“I thank una well-well. Una dey ginger me. Na just half of di journey wey we start 24 months ago we don go. Together we promise say we go face Nigeria wahala head-on, rebuild trust, bring better life, and fix our economy.”
E come thank Federal Executive Council members say dem get courage to push di vision of better Nigeria. E also hail di National Assembly and party leadership for their full support.
E add say:
“Our reforms dey work. Nothing good dey come easy for life. Na only hard decision fit bring better future. We no fit dey borrow chop di future of our children wey never born.
“With Renewed Hope Agenda, we promise say we go fix di economy, improve security, reduce corruption, change how government dey work, and help people comot from poverty.”
Tinubu come drop one strong talk:
“How you wan take rebuild country if you allow exchange rate corruption continue? Na that kain thing EFCC take recover over 750 houses from one person.”
E admit say di reforms hard, but e talk say dem dey important and necessary.
“Yes, when we enter office for May 2023, wahala full ground. But we don dey make progress with tough but important reforms. We don remove the many foreign exchange rates wey dey help corruption, and our tax reforms dey come.
“Because of di reforms, foreign investors don dey show interest in Nigeria, and e go bring jobs and better things wey go improve people life,” Tinubu talk.


No be small problem for the country