Actor Ugezu J. Ugezu don beg Nigerians wey dey reason to run go another country make dem "reason am well" before dem comot.
E talk say one correct medical doctor for Naija wey dey do well sell im clinic and all wetin e get, go abroad, but na butcher e turn for meat shop.
"A lot of things no be as dem dey look. Make una shine eye," na wetin the actor talk be dat.
"Before you comot... reason am," e still talk.

