Doctors tall say my pikin no go Waka aga Ex BBN star Nina shares

Doctors tall say my pikin no go Waka aga Ex BBN star Nina shares

Former Big Brother Naija star, Nina Ivy, don come remind people say sometimes, na mama or papa instinct dey pass wetin doctor talk.

For her Instagram Story, Nina yan say one time, doctor tell her say her pikin Denzel wey dem born premature, fit no waka at all. Doctor come suggest make she carry am go therapy. But she no gree.

She talk say, “I look the doctor for face tell am say, ‘My pikin go waka when e time reach.’”

And true-true, Denzel waka — before him even clock one year.

She no stop there. Nina still warn people make dem no just dey believe wetin doctor talk anyhow:

“Plenty doctors go give you medicine wey go cause more wahala… Make una shine una eye.”

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *