One police inspector wey dem dey call Musa Kampani don kpai as stray bullet jam am during patrol for Song–Gombi Road inside Song Local Government Area for Adamawa State.
According to tori wey come from Adamawa State Police Command, di wahala happen around 11:00 a.m. on Sunday, May 25, 2025, when police dey do normal patrol and stop-and-search with Safer Highway Patrol team.
Dem talk say di police stop one man wey enter keke and carry dane gun, and di man no wear uniform.
When dem ask am who he be and wetin give am right to carry gun, di guy no fit explain well.
Na so kasala burst, and na that time some people from Hunters and Civilian Joint Task Force (JTF) waka come the place come begin shoot for air.
Na for that confusion wey stray pellet take jam Inspector Musa Kampani.
The Divisional Police Officer (DPO) for Song quickly carry team go the area.
Dem rush the inspector go Cottage Hospital for Song, but doctor talk say he don already die before dem reach.
Dem don carry him body go mortuary make dem do autopsy.
Meanwhile, the Hunters/Civilian JTF Commander, Adamu Zubairu, don dey for police hand, and dem dey find other people wey run.
The State Criminal Investigation Department (SCID) don begin full investigation on top the matter.

