Ebenezer Obey, KWAM 1, Kiekie and oda people shell Ijebu Ode for ‘Evening with Glo’

Ebenezer Obey, KWAM 1, Kiekie and oda people shell Ijebu Ode for ‘Evening with Glo’


Juju music legend, Evangelist Ebenezer Obey Fabiyi, and Fuji king, Wasiu Ayinde Marshall (KWAM 1), bin burst Ijebu Ode people brain on Friday for one better show wey Globacom organise to take start di 2025 Ojude Oba celebration.

Dis year own mark 20 years wey Glo don dey support Ojude Oba festival, and dem don use di support turn am to big cultural event wey even people from abroad dey come watch.

Dem call di event “Evening with Glo”, and e full with enjoyment – better music, sweet food, and plenty laugh wey Gbenga Adeyinka, Bash and Kiekie deliver well well.

For more than two hours, Ebenezer Obey dey drop him evergreen music, and di crowd wey full everywhere dey dance, sing along and enjoy every beat.

Glo talk say dem do di “Evening with Glo” to take thank di Ijebu people for di love wey dem don show di brand for 20 years as sponsor of Ojude Oba festival.

“We wan bring all di correct sons and daughters of Ijebuland together to celebrate wetin join us together – our culture and sweet music wey all Yoruba land sabi,” na so Glo talk.

As Glo dey yarn why dem choose di musicians wey perform, dem talk say: “Chief Commander Ebenezer Obey na legend wey don give us plenty wise and sweet music for many years. Even till today, him songs still fresh and full of better advice.”

On top KWAM 1 matter, Glo talk say: “King of Fuji, K1 De Ultimate, don dey give us him special Fuji style for decades now, and people no dey tire to listen to am.”

Local people wey show face

Big people from Ijebuland like di Olori of Oba Awujale, Chief Mrs. Olukemi Adetona; Professor Fassy Yusuff wey be di head of Ojude Oba Festival Planning Committee; and Chief Mrs. Bisi Osibogun wey be one of di committee members and Iyalode of Ijebuland, all show face for di event.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *