One 23-year-old man wey dem call Chiemelie Nnaji don kpai afta im drown for river during deliverance for Enugu.
According to The Nation, Chiemelie dey popular for Obiagu side because e dey roast pork and chicken for front of one motel.
Pipo for di area sabi sey di young man dey battle epilepsy.
Dem talk sey di wahala happun Thursday aftanoon, 5 June, wen Chiemelie mama, wey everybody sabi as Ezenwanyi, carry am plus one middle-aged client go one river wey dem dey call Mmiri Ani for Obiagu, Enugu, to do spiritual cleansing. Ezenwanyi bin dey train Chiemelie make e take ova di work.
As dem dey inside water, Ezenwanyi use native fowl dey do di ritual. Na den epilepsy catch Chiemelie again; im fall inside di river wey reach chest level.
But Ezenwanyi, wey “spirit” don hold, just continue dey chant incantation, no gree help di pikin—even afta di client shout sey di boy dey drown.
Na di female client end di ritual by force, raise alarm; neighbours rush come, dive enter water, drag Chiemelie commot. By dat time e still dey breathe small. Unfortunately, two hospital reject am; na for di third one dem pronounce am dead.
One eyewitness yarn:
“When we reach di river, we see Ezenwanyi dey chant, di other woman dey cry. We manage bring di boy commot, rush am hospital. Two hospital no gree admit am. Na di third hospital talk sey e don die.”
Police for Enugu don arrest di spiritualist.

