Media man, Rufai Oseni, don ask Senate President Godswill Akpabio media aide, Kenny Okolugbo, make e tell Nigerians how e take recover im X handle sharp-sharp afta e talk say hackers bin take over am.
Dis morning, Nigerians wake up see say Okolugbo X handle dey post message wey talk say e join plan wey dem do to bring down Senator Natasha Akpoti-Uduaghan and spoil her name. Di message even beg di Senator make she forgive.
But later, Okolugbo come talk for di same handle say hackers bin hijack am, and say e don manage collect back im page. E deny say na im write those tweets.
As Rufai hear dis kain tori, e come ask am make e show proof say dem really hack am and how e take get di account back quick like that.
Read wetin Rufai post below:

