Chelsea don complete deal wey carry teenage defender Mamadou Sarr comot from Ligue 1 club RC Strasbourg.
Di 19-year-old French player don sign contract wey go last reach 2033.
Sarr, wey dey play for France U20 team, play important role wey help Strasbourg qualify for Europe next season. E make 28 appearances for all competition dis season.
Chelsea talk say: “Him talent don show well well as e don represent France for different youth levels, latest one na for under-20 team.”
“Welcome to Chelsea, Mamadou!”
Sarr make 29 appearances for di club dis season as dem qualify for UEFA Conference League.
E don also play for France U17, U18 and U19.
Dis move dey happen same time striker Liam Delap don also waka enter Stamford Bridge dis summer, while winger Jadon Sancho don confirm say e go return Manchester United as him loan don finish.
Sarr go fit join Chelsea for Club World Cup wey go happen for United States, and dem first match na against LAFC on June 16.

