Kidnappers don release the dead body of one retired Army Major wey him name na Joe Ajayi, after dem collect N10 million ransom for Kogi State.
Di retired soldier bin dey inside him house for Odo-Ape, for Kabba-Bunu local government area of Kogi, when gunmen kidnap am around 11:30 for night on Wednesday, May 21, 2025. Di kidnappers fire gun anyhow before dem carry am go one place wey nobody sabi.
Tori wey reach us be say, di kidnappers first ask for N50 million, but him family no fit raise dat kain money. As time dey go, di man health come dey worse because e no get access to medicine.
Di kidnappers come talk say if dem wan send medicine come meet am, e go cost extra money, but di family no fit meet up. When dem see say Major Ajayi no go survive again, na im dem reduce di ransom to N10 million.
One person from di community yarn say di family think say di man still dey alive, so dem rush pay di N10 million wey dem request.
But after dem pay, di kidnappers tell dem where to go find am. Na so dem reach di place, only to see say di man don die.
Dem don carry di Major dead body go put for Kabba Specialist Hospital mortuary.

