Actor Gideon Okeke don reason why dem dey allow cattle herders carry weapons like cutlass and machete, but wahala come burst when one man of God carry sometin wey resemble gun.
For him Instagram page, Gideon drop post wey e take ask whether pastors and cattle rearers no be the same kind citizens for dis country.
Him question come follow the trending video wey show Lagos pastor, Paul Adefarasin, wey dem accuse say e flash weapon give one content creator wey dey record him motor for Lagos street.
See wetin him post talk below…

