Dem suspect say some motorcycle snatchers don k!ll one Okada man wey dem identify as Joseph Abeegye for Makurdi, Benue State.
Di incident happen for Nyesom Wike Street on Monday night, June 16, 2025.
Tori wey reach people hand talk say di attackers ambush Joseph, shoot am, and run commot with him motorcycle.
One family member, Elder Murphy Jude Tsetim Ormbagwen, confirm di sad news for Facebook.
Na wetin he write be this:
“The worst don happen to me this night. Bike snatchers shoot my cousin Joseph Abeegye d3ad and carry him bike this night for Nyisom Wike Street. Kai God.”
