Katakata bust as ex-convict try escape from court for Ilorin

Katakata bust as ex-convict try escape from court for Ilorin

Wahala shelle for one Area Court for Ilorin on Tuesday, June 24, as one ex-convict wey dem dey call Segun Samuel try escape from the court premises.

According to prosecuting officer, ASP Samuel Mayowa, wey yarn with NAN, the ex-convict use broomstick smartly take remove the chain wey dem put for hin leg. After that, he waka go bathroom then jump court fence try run.

ASP Mayowa talk say, “Dis guy get four different criminal cases for dis same court. One of the cases dem judge am on Monday wey dem sentence am to one year for prison. Another one, dem give am six months community service. Today na the third one dem suppose hear before he carry this escape stunt.”

Luck shine on the prison warders and police officers for court premises as dem quickly pursue am.

Later, with the help of community people and serious search, dem catch am inside one tattered building for Oke-Suna area for Ilorin.

Mayowa come add say the Correctional Service officer wey dey in charge don carry am go back to custody.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *