One former nurse don land for serious gbege as she pay one of her patient $3,000 to cut her ex-boyfriend p£nis and tongue, plus pour acid for him face.
The nurse wey her name na Karenjeet Kaur Warburton, don collect 4 years ban from doing any work wey relate to health care.
This judgement na from Queensland Civil and Administrative Tribunal wey publish the case last week. The matter first shelle around March.
One tribunal member, Julie Dick, talk say Warburton bin approach one patient wey she think say fit help am seriously injure her ex-boyfriend, wey be senior Queensland Police Inspector Don McKay.
How the gbege take start
Warburton and Inspector McKay bin dey date from March 2020 till early 2021.
Between April 1 and October 6, 2021, she give the patient wey dem call Andrew Bown pictures of Inspector McKay and where him dey stay. She come give am $3,000 make e carry out the wicked plan.
The evil plan
Julie Dick write for the tribunal say:
"She don already pay plenty money, and still offer more money give the person wey go do the work."
"Warburton tell one undercover police say make dem cut McKay p£nis and tongue, burn him face with acid, cut him spine with knife to make am paralyze, or even break all him bones so e no go fit waka or talk again."
Na only arrest stop Warburton from carrying out the evil plan.
The punishment
She plead guilty for court for two charges:
- One na attempt to cause serious bodily harm
- The second one na attempt to do evil act with full intention
The court sentence her to 5 years imprisonment, but she go serve 16 months before dem suspend the rest.
For the health tribunal, she no deny say she commit serious misconduct by involving her patient for her revenge matter.
So dem ban her from working for health sector for 4 years — including the time wey she don already stay for prison.
Julie Dick write say:
"It bad say this kain serious behavior don put her for this kind wahala. She go need reapply for license again, and she go face plenty new conditions before dem fit allow her practice again."
The patient wey follow do the plan
Andrew Bown, the patient wey collect money from her, also get him own punishment.
Dem charge am with arson (burning), attempt to help cause grievous harm, and possession of dangerous item to help commit crime.
He get 3 and half years prison sentence from Cairns District Court for November 2022.

