Bariga Local Council Development Area (LCDA) for Lagos don officially change the name of the popular Charly Boy Bus Stop to Baddo Bus Stop, to honour popular Nigerian rapper, Olamide Adedeji, wey people sabi as Baddo.
Dem announce the new name for the bus stop on Friday, July 25.
Chairman of Bariga LCDA, Kolade Alabi David, na him talk this one during the commissioning of some projects for the area.
The Charly Boy bus stop before now dey bear the name of entertainer Charles Oputa, wey people sabi as Charly Boy. As at now, Charly Boy never talk anything about the change.

