former Ekiti state governor, Ayo fayose don talk say Nigerians na only when pesin die dem dey praise am.

former Ekiti state governor, Ayo fayose don talk say Nigerians na only when pesin die dem dey praise am.


For one fresh interview with Channels TV, Fayose talk say he no go follow people wey dey hail late President Muhammadu Buhari government because he no be fan at all. He come add say, as e take be for him own eye, Tinubu don try well well since he enter office two years ago.

Dem come ask am say wetin about him closeness to President Tinubu and whether e no dey fear say people go forget say he dey always talk truth to power about wetin dey happen for the country. Fayose reply say:

“No be emotion matter be this. Even if you carry Jesus Christ come this country today, or you bring Allah, dem go still criticize am.”

He come still talk say:

“Nigerians na only dead body dem sabi praise ooo… When President Buhari kpai, I wan come out come talk wetin dey my mind abuse am. Na my wife beg me say, ‘My husband abeg no talk anything.’

You fit talk say Buhari try? Me I no dey among people wey dey praise dead body oo. Make una no come dey honour me when I kpai.

When Buhari dey power, all of us know as things be, so make nobody come dey tell me say Tinubu no dey try, just for ordinary reason say the man dey accessible. Buhari dey accessible that time?

All those things wey dey happen that time, you still dey see dem now? You don ever see one country wey everything just dey perfect? I no agree with you.

Even if you bring our Lord Jesus Christ make e rule, carry Pastor Adeboye, bring Pastor Kumuyi, put all the spiritual leaders together, dem go still abuse dem!

So, as e be now, Nigeria for me, so far, so good.”


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *