kim kadashian don reacts to Paris robbery convictions

kim kadashian don reacts to Paris robbery convictions

Almost ten years after dem rob Kim Kardashian for Paris, tie her up and point gun for her head, eight people don finally chop guilty for the matter — but none of dem go go back prison.

The robbery happen during Paris Fashion Week for 2016, wey Kim lose jewelry wey worth over $9 million, including one engagement ring wey cost $4 million. Dem gag her, tie her with zip tie, and lock her inside bathroom for one luxury house.

According to Daily Mail, dem call the convicted group “Grandpa Robbers” because many of dem na old men wey dey their 60s and 70s. Dem give dem sentence from 3 to 8 years, but na mostly suspended sentence because of their age and health wahala.

The court talk say the thing pain Kim well, but to send dem go jail again no go make sense because some of dem dey sick — one dey do chemotherapy, another get Parkinson’s, and one no dey hear well so dem even need display court talk for screen make he see.

Out of the ten wey dem put on trial, na only two confess. The person wey plan the whole thing, Aomar Aït Khedache, 69 years old, get eight years, but because of time wey he don already spend and suspended sentence, he no go return jail.

Kim no show for court on Friday, but she talk say the experience na “the most terrifying of my life.” Since then, she don tighten her security and stop to dey post things live for social media.

She still talk say, “Even though I no fit ever forget wetin happen, I believe say people fit grow and take responsibility.”

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *