Comedian Seyi Law don react to tori say Cubana ChiefPriest go visit President Tinubu for State House.
For one post wey he drop for him X (Twitter) handle, Seyi Law talk say people like Cubana dey come online dey follow the mob wey dey bash government, but for back, dem dey run go dey collect from the same government. He still talk say na God and time go judge dem. He also yarn say President Tinubu even call internet person Tunde Ednut on him birthday, and the guy happy well-well.
Make una remember say Seyi don chop plenty dragging online when he come out openly support Tinubu government. After Cubana Chief Priest post pictures of himself with President Tinubu, many Nigerians begin mock Seyi say even with all him support, he never see President, but Cubana don go chill with am.
Read wetin Seyi write below…

