Influencer Priscilla Ojo don drop more wedding pictures with Tanzanian singer, Juma Jux

Influencer Priscilla Ojo don drop more wedding pictures with Tanzanian singer, Juma Jux


Despite di warning wey Tanzanian media personality, Mange Kimambi give her, Priscilla — wey be actress Iyabo Ojo pikin — still go ahead drop more pictures from her wedding with Tanzanian singer, Juma Jux.

Mange bin post for her Instagram page on Friday, June 6, beg Priscilla make she stop to dey post anything about di wedding, say Tanzanians dey lose focus from serious matter like di call for electoral reform before their national election.

But e be like say Priscilla no send, as she don still drop more wedding pictures. For one of di captions, she write:

"Thank God say man nor be God."

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *