Super Eagles striker, Victor Osimhen don accept Al Hilal contract to move go Saudi

Super Eagles striker, Victor Osimhen don accept Al Hilal contract to move go Saudi


Super Eagles and Napoli striker, Victor Osimhen, don finally gree personal terms with top Saudi Arabian club, Al Hilal.

Before before, di striker waka comot from di negotiation table because dem no gree give am wetin im dey ask — €40 million per year.

But now, tori don change. Reports dey talk say dem don reach agreement wey go pay am €30 million per year for four years.

According to journalist Sacha Tavolieri, Osimhen don gree personal terms with Al Hilal, and dem go dey pay am about $35 million (about £29m or $40m) as base salary, plus add-ons.

Even though dem don settle with di player, Al Hilal never still gree price with Napoli.

Journalist Gianluca Di Marzio talk say di highest offer wey Al Hilal don give na €70 million (about £59m or $80m), but Napoli dey insist say dem want €75 million (about £63m or $86m).

Negotiation still dey go on between both clubs for transfer fee.

If Al Hilal fit seal di deal on time, dem go fit use Osimhen for di FIFA Club World Cup, as di mini-transfer window go close on June 10.

This latest development na big gbege for Turkish champions Galatasaray, wey dey try make Osimhen stay with dem after im loan spell wey sweet. Di striker score 37 goals inside 43 matches for dem.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *