Police don arrest 13 people for Kawo area for Kaduna State afta one suspected phone thief k!ll one naval officer, Lt. Commodore M. Buba, on Sunday, June 8.
Di spokesperson of Kaduna State Police Command, DSP Mansir Hassan, talk say di officer wey die na senior course student for Armed Forces Command and Staff College, Jaji. Dem attack am and stab am for chest with knife around 5:20am for one bus stop near Kawo flyover.
As police yarn, di officer bin dey come from Jaji wen im motor get flat tyre. As im come down make e change di tyre, one guy waka come out from nowhere, begin demand make im hand over im phone.
Di officer no gree give am di phone, so di guy stab am for chest with local knife.
But di thief no escape as people for area gather, beat am well well and k!ll am there for di spot. Dem rush di officer go Manaal Hospital, but doctor talk say im don already d!e before dem reach.
Afta di kasala, police say dem raid di Kawo area come arrest 13 suspects wey dem catch with knives and other dangerous items.

