I go clear my schedule to visit Benue people on Wednesday – President Tinubu

I go clear my schedule to visit Benue people on Wednesday – President Tinubu

President Bola Tinubu don shift him official waka wey suppose carry am go Kaduna State, say instead, na Benue he go visit on Wednesday, June 18, 2025.

According to wetin him media aide, Bayo Onanuga, talk, the visit na part of effort to bring peace and find solution to the wahala wey dey disturb communities for the state.

Di statement talk say:

“President Tinubu wan see with him own eye wetin dey happen for Benue—especially the serious crisis wey don k!ll many people and destroy plenty properties.”

“As him go land, he go meet with traditional rulers, political and religious leaders, community heads, and youth groups to talk how peace fit return to the land.”

Before the visit, Tinubu don already send people ahead go Benue, including:

  • Secretary to the Government of the Federation (SGF)
  • Inspector General of Police (IGP)
  • Heads of intelligence agencies
  • National Security Adviser (NSA)
  • Senate and House Defence Committee Chairmen

Dem go prepare ground for am, as him go also hold town hall meeting with everybody wey matter for the state.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *