Gist don enter say socialite wey everybody sabi as Cubana ChiefPriest don file court case against one Kenyan woman wey dem dey call Hellen Ati, wey dey claim say he na the papa of her pikin. According to Nigerian lawyer Emeka Ugwuonye, na him drop this tori for Facebook today, as he share one court document wey dem say Cubana ChiefPriest submit for Kenyan magistrate court.
For the court paper, Cubana ChiefPriest dey beg make court stop Hellen from dey talk bad about am for social media.
Dem say Hellen don dey drag Cubana ChiefPriest online steady, dey talk say her two-year-old son na him born am. She dey demand make he come do DNA test and take responsibility for the pikin. But the socialite don deny say he ever know the woman or get anything to do with am.
Na serious gbas gbos dey play out for this matter o.

