Good news when don shele from one atress for america na him show below

Good news when don shele from one atress for america na him show below

Amber Heard don announce say she don born twins for one Instagram post wey she share on Mother’s Day for America.

Di American actress talk say she welcome her pikin – baby girl wey her name be Agnes and baby boy wey she name Ocean – and she talk say she too happy reach where words no fit explain. She say di arrival of di twins don complete her family.

Heard wey be 39 years old, first born her first pikin, Oonagh, for 2021.

Under one photo wey show three pairs of leg, she write say: “To become mama on my own and do am the way I want despite say I face wahala with my fertility na one of di most humbling things wey don ever happen to me.”

Di actress talk say she choose to become mother “with sense and plenty thought” and say she too happy reach to burst. She describe her family as the one wey she don dey pray and work towards for many years.

She come add: “To all di mamas, anywhere una dey today and no matter how una take reach there, me and my dream family dey celebrate with una.”

When she born her first pikin for 2021, she tok say she want make people begin see am as normal say woman no need ring (marriage) before she fit get crib (pikin).

She come write say: “I don begin appreciate how strong e be for women to choose say dem go plan dis part of life by themselves.”

Amber Heard na actress wey people sabi from films like The Rum Diary, Drive Angry, Zombieland and Aquaman.

She bin marry actor Johnny Depp from 2015 go 2016. After dem separate, both of dem accuse each other of domestic violence, and the matter cause big wahala for court.

For 2020, Johnny Depp lose court case for UK against The Sun newspaper after Amber give evidence say he be “wife beater.”

For di popular US case of Depp vs Heard for 2022, court rule say Heard defame Depp. Di case last for six weeks for Virginia, USA. Depp sue her because of one article she write for The Washington Post wey talk about domestic abuse, even though she no call his name.

Court come award Depp $15 million as damages, while Heard win one of her own counter-claims and dem award her $2 million.

Na so di matter take go.

th (4)
This is an Image Box
Lorem Ipsum has been the industry's standard dummy text ever since the 1500s, when an unknown printer took a galley of type and scrambled it to make a type specimen book.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *