One Woman person when dey act film for nigeria don talk why she dey sleep for church for like 6 solid years now o.. kia she marry Church neh abi pastor own am something? Make una read am below

One Woman person when dey act film for nigeria don talk why she dey sleep for church for like 6 solid years now o.. kia she marry Church neh abi pastor own am something? Make una read am below


Veteran Nollywood Actress Jumoke George Don Cry Out: “I Don Dey Live For Church for 6 Years, My Pikin Still Lost”

Veteran Nollywood actress Jumoke George don open up for one emotional interview say she don dey live inside church for the past six years after dem pursue her comot from her house because she no fit pay rent.

As she dey talk with tears for TalkToB show hosted by Abiola Adebayo, she explain say she hide her condition because of shame and fear of wetin people go talk.

She talk say her health don fall, she no fit go location for work again, and she even borrow money refund person wey pay her last year. Another test wey dem say she must do go cost ₦400,000, and she no know where she go get the money.

“Na church I dey sleep. I dey lay mattress for floor for one small space dem give me. Na mummy church dey give me food, dey boil herbs for me. I no talk before because of shame,” she talk as she cry.

As if health wahala no do, Jumoke reveal say her first daughter, Adeola, don miss for four years. The girl waka go look for greener pasture and call one day say make she forgive am, but since then, no trace of her again.

“Na me dey take care of her children now. Their papa don disappear, I no sabi where him dey,” she add.

She still talk say her son Ife don borrow close to ₦2 million to take care of her and pay for treatment. She dey fear say all the debt fit cost am him job.

Finally, she beg people:
“Pain no good. Make una help me with prayer. I no know whether na spiritual. I don tire. No house, one pikin miss, health don spoil. Abeg, pray for me.”


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *