Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don comot Elie Bitar, wey be foreigner, from dia wanted list afta dem first declare am and seven oda people wanted because of di wahala wey happen for Crypto Bridge Exchange (CBEX) fraud matter.
EFCC bin declare Elie Bitar, 41 years old, wanted on May 1 because dem believe say e dey involved for di CBEX fraud. You fit read am for here
But today, May 14, EFCC release statement say dem don comot Bitar name from di wanted list. For di same statement, dem still tok say dem still dey find all di eight people wey dem believe say get hand for di fraud wey make many Nigerians lose money.
“CBEX: EFCC Dey Double Dia Effort to Catch People Wey Dem Declare Wanted”
As part of di investigation wey EFCC dey do on top di big fraud wey involve many people for di popular Crypto Bridge Exchange (CBEX), di EFCC don dey progress wella to track di eight people wey dem declare wanted for di matter.
Di people wey still dey wanted list na: Seyi Oloyede, Emmanuel Uko, Adefowora Oluwanisola, Adefowora Abiodun Olanipekun, Johnson Okiroh Ofienolu, Israel Mbalika, Joseph Michiro Kabera and Serah Michiro. Ellie Bitar from CBEX Solutions Ltd. wey dem first put for wanted list don comot because new information show say e no suppose dey di list.
EFCC talk say dem dey make good progress with dia investigation and law enforcement people from oda countries don join hand to help track and arrest di people. EFCC tok say dem no go rest until dem catch everybody wey get hand for di fraud.

