Nigerian singer Omah Lay don enter people mouth again afta im drop one raw and deep post wey touch im mental state.
For X (Twitter), he just write: “Clarity Of Mind. Money is everything.”
Dis message touch plenty people, especially as dem sabi say he don talk about depression before. Him old songs sef dey show say he dey fight plenty emotional wahala — like person wey dey battle inner demons and tire for life.
For 2022, e shock fans when he talk say him mental health fall worse afta im knack im therapist.
Now, dis new post dey show say him mindset don dey change — e no just be about healing again, but how im dey see clarity and the role wey money dey play for everything.

