Formal Vice president don Yan one better Tok concern the action of Boko Haram…

Formal Vice president don Yan one better Tok concern the action of Boko Haram…


Former Vice President Atiku Abubakar don talk say na former President Olusegun Obasanjo quick quick take end Boko Haram wahala when dem first show face for dia time.

Atiku yarn this one for Abuja on Wednesday when stakeholders from Kogi East Senatorial District wey former Kogi State Deputy Governor, Simon Achuba lead, come visit am. Atiku say na strong political will help dem take clear the insurgents early that time.

For one video wey Atiku post for him Facebook page, e talk say Boko Haram first show for Yobe State around 2002. E say Obasanjo come call am make dem reason wetin to do.

Atiku talk say, “Una remember when Boko Haram first start for Yobe? E happen for 2002. Na that time we still dey office. President send for me. E say, ‘VP, wetin we go do about this matter?’ I tell am say, ‘Oga President, make we summon all the Service Chiefs. Give dem deadline. If dem no fit end am, make dem drop uniform go house. We go find people wey go do the work.’

“And na so e call the Service Chiefs, I dey there. E give dem serious instruction. Within few weeks, dem don finish the insurgency for Yobe. That Boko Haram no raise head again till we comot for office.”

Atiku still blame the way Boko Haram later come back strong on top say the leaders wey come after dem no do the needful.

E talk say, “Wetin I go talk be say our leaders no get the political will. When dem dey kill your people, how you wan take chop? Dem dey kill your citizens and you no send? Na the highest level of irresponsibility be that for any leader.

“So me, I dey hold our leaders responsible for all the insecurity wey full everywhere,” Atiku yarn.

Atiku bin serve as Nigeria Vice President from 1999 go reach 2007 under President Olusegun Obasanjo during the Fourth Republic after military rule end.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *