Hand don catch am.. finally them don gbab the wanted kidnapper for Nasarawa State…

Hand don catch am.. finally them don gbab the wanted kidnapper for Nasarawa State…

Di Nasarawa State Police Command don talk say dem don catch one notorious kidnapper wey don dey for dia wanted list for plenty bad crimes.

For one statement wey dem give journalists for Lafia on Sunday, May 18, di Command Public Relations Officer, SP Ranham Nansel, yarn say na serious manhunt lead to di arrest. “Dem catch di man, Abashed Gizo, for Shingle market, Cattle market side for Lafia, through correct intelligence work by State Criminal Investigation Department (SCID).”

Di suspect don dey for wanted list for long time because of different crimes like kidnapping and cow stealing. “As dem interrogate am, di guy confess say na true, and e even carry police go him hideout for Ruwan Baka village, Doma LGA, where dem recover one AK-49 rifle (Breach №453144) and one magazine from am.”

Di Command talk say di arrest na big breakthrough, especially as e connect with di case of Fatima Salisu, wey dem catch when she dey carry plenty bullets from Doma go Katsina State to supply criminals.

Di Commissioner of Police, CP Shetima Jauro Mohammed, talk say dem no go rest until dem wipe out crime for Nasarawa State and make sure say everybody dey safe.

Police still dey beg people make dem shine eye well well and report any suspicious movement, as dem dey work hard to make everywhere safe.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *