Actress Angela Okorie don sama her formal boyfriend busha as she say he wan use style style enter her like again as her guy

Actress Angela Okorie don sama her formal boyfriend busha as she say he wan use style style enter her like again as her guy


Angela Okorie don release chat wey she say na her ex-boyfriend send, dey beg make she allow am come back into her life.
Di actress wey before don accuse her ex say na she him use take reach other Nollywood actresses, still share some chats wey she say show say the guy dey toast other actresses while dem still dey together.
She talk say after dem break up, di guy begin talk plenty lies about her, and she swear say she no go ever take am back.
She even talk say di guy send her N1.5 million just to win her back, but she say na waste of time.
She still blast am say him post picture of both of dem together just to try win her heart again.
See wetin she post below.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *