Nimet don talk say 3 days sun go shine and weather no go clear  full story dey down

Nimet don talk say 3 days sun go shine and weather no go clear full story dey down


Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don talk say from Sunday, May 18, go reach Tuesday, May 20, weather go mix – sometimes sun go shine, sometimes e go cloudy, and thunderstorm go show for some places across Nigeria.

For one statement wey dem drop for Abuja, NiMet explain say different areas go see different kinds of weather, and dem warn people make dem take caution, especially because of thunderstorm and strong breeze.

For Sunday, NiMet say most parts of the North go dey sunny with small clouds. But later for evening, thunderstorm fit fall for places like Gombe, Bauchi, Kaduna, Taraba, and Adamawa. For North-central, sun go dey with small chance of thunderstorm for places like Kwara, Plateau, Nasarawa, Niger, Benue, and Kogi for afternoon or evening.

For South, early morning thunderstorm fit show for Cross River, Lagos, Ogun, Bayelsa, Rivers, Delta, and Akwa Ibom. Dem still expect more thunderstorm later in the day.

On Monday, May 19, sun and small clouds go still dey North. Taraba and Adamawa fit see thunderstorm in the morning, and later for afternoon or evening, more thunderstorm fit show for Kaduna, Taraba, and Adamawa. For North-central wey include FCT, Niger, Kwara, Benue, Nasarawa, Kogi, and Plateau – dem too go get small thunderstorm later for the day. For South – places like Ondo, Ogun, Lagos, Cross River, and Akwa Ibom – morning thunderstorm go dey, and more rain fit fall later for afternoon/evening.

By Tuesday, the pattern still continue. For North, morning go get sun with small clouds, but isolated thunderstorm fit fall for Taraba, Bauchi, Gombe, and Adamawa. Later, more rain go fall for Borno, Yobe, Jigawa, Katsina, Kano, Kaduna, Adamawa, and Taraba.

For North-central, sun go still show with small cloud, but thunderstorm fit fall later for FCT, Nasarawa, Kogi, Plateau, Benue, and Niger. For South – early morning thunderstorm fit happen for Cross River, Lagos, Bayelsa, Rivers, and Akwa Ibom – and more go still fall as day dey go.

NiMet warn people make dem take caution during thunderstorm time. Strong breeze fit blow, so make people hold their properties well, no drive when rain heavy, unplug electric appliance, and avoid to stay under tall trees. Dem also tell airline operators make dem dey check with NiMet for latest weather update to plan their flights well.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *