VJ Adams don blast one man oo.. he even reach call am IDIOT…

VJ Adams don blast one man oo.. he even reach call am IDIOT…

Media personality VJ Adams don call young men out for dey focus on wrong things when e concern dating and relationship.
For one trending video, the TV host talk how women dey approach relationship different from men, say women dey always ask serious questions when dem meet man like, “Wetin e dey do?”

But VJ Adams talk say men no dey check these important things, dem dey only look how person fine.
He talk say: “Afa, see young boys... I no know, by now, una still no get sense, but I go help una, that na why ègbón adugbo dey here. Make una look una female padi dem, anytime dem dey talk among dem and one wan introduce new guy, the first question wey dem go ask be: Wetin e dey do? Dem wan check if e don ask dem out before or if e don toast dem before. But Sheri, una boys na idiot, idiot. Omo, this your baby carry sha… no dey ask important questions at all.”

download (19)

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *