NSCDC don arrest one man wey them suspect say an ritualist for Ogun state full story dey down

NSCDC don arrest one man wey them suspect say an ritualist for Ogun state full story dey down


Di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) for Ogun State don arrest one man wey dem suspect say be ritualist, sake of say e injure one two-month-old baby seriously.

Di spokesperson for di command, Dyke Ogbonnaya, talk this one for one statement wey e release on Monday, May 19, 2025. E talk say dem arrest di suspect after one man, Kola Taiwo, give dem correct informate.

“On Thursday, May 1st, 2025, NSCDC for Ogun State Command Headquarters, Abeokuta, arrest one man wey dem suspect say na ritualist. Im name na Samuel Adebisi Adewunmi, wey people sabi as Ifa Science, for injuring one two-month-old baby badly,” di statement talk.

Di tip-off come from Kola Taiwo, one 53-year-old man, wey notice say dem cut something comot from back of im pikin head.

As officers and men of di Corps hear wetin happen, dem quickly go arrest di suspect. Right now, di man dey under investigation with di intelligence and investigations department for di State Command.

Di offence wey di man commit dey under di Criminal Code Laws of Ogun State, and NSCDC talk say dem go do everything wey dey their power to make sure say justice go happen sharp-sharp.

Commandant Remilekun Omolade Ekundayo, when she react, warn parents make dem dey very careful and always know where their children dey. She still warn anybody wey get bad mind to harm another person say make dem ready face di consequence, because di Corps no go ever waste time to use full power of law punish anybody wey do dis kind wicked thing.


Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *