One plane don crash for inside residential area for San Diego, California. People wey see am don share pictures for social media, wey show say serious fire dey burn for middle of the street.
The crash happen small time before 4am local time on Thursday, May 22, for one place wey dem dey call Murphy Canyon for San Diego.
Police for the area talk for Instagram say: “We dey respond to one plane crash wey happen for around Sculpin Street and Santo Road. Make una no near the area make emergency people fit do their work well. We go give more info as e dey come.”
San Diego Fire Chief, Dan Eddy, yarn say the crash don damage like 15 houses. Firefighters still dey search plenty houses for four blocks to make sure say everybody don comot, as jet fuel scatter everywhere.
Chief Eddy still talk say when the plane crash, the fog thick well well — you no even fit see front. And when dem reach there, dem see say many motors don catch fire. But dem don quench all the fire now. Their main focus now na to make sure say people wey dey nearby dey safe.
Federal Aviation Administration (FAA) confirm say the plane wey crash na Cessna 550, and e crash near Montgomery-Gibbs Executive Airport.
The plane fit carry up to eight people, but FAA talk say dem never know how many people dey inside when e crash. Dem also talk say na the National Transportation Safety Board go lead the investigation.

