One court for Izzi, wey dey Abakaliki – Ebonyi State capital – don sentence one 30-year-old man, Boniface Abraham Edigbo, to death by hanging after e k!ll one 18-year-old boy wey be SS2 student.
Di reason na say di boy, Ogbonna Joshua, bin tell pipo say him and Boniface dey do homosexual things since 2021 and say e don dey get serious problem for him nyash (anal issues) because of am.
Dem say after the matter leak, Boniface lure di boy go one hotel – Edigbo Guest House – for Monday night, May 22, 2023. Na there dem get one last sexual contact. Di next morning, Tuesday, May 23, Edigbo poison di boy with Fanta and insecticide mix. Di boy drink am, and he die.
After di boy kpai, Edigbo run go meet one woman talk say e no wan k!ll am but na because di boy go expose their relationship. Di woman pretend say she wan go bring money make he escape, but instead she report am to community youths.
Dem catch am, carry am back to di hotel where dem find di boy lifeless for Room 006.
On Friday, June 13, 2025, Justice Ruth Okeh find Boniface guilty and sentence am to death by hanging.
Di lawyer for government side, Mrs Ijeoma Mike-Aja Nwachukwu, talk say di judgment go serve as strong warning to others wey dey do this kind evil for society.

