18-year-old boy wey dem identify as Yaw Brakoh, wey people sabi as “2 Cedi,” don land for police hand over alleged k!lling of him grandmother for Wassa Adansi inside Amenfi East Municipality for Western Region, Ghana.
The incident wey happen on Wednesday morning, May 17, 2026 for the old woman house, don leave many residents for shock and sadness.
According to reports, the suspect allegedly attack and cut off him grandmother head under circumstances wey police never fully explain.
People for the community quickly gather manage catch am before handing am over to Wassa Akropong Police Patrol Team.
Angry mob nearly lynch am before police enter rescue am to stop more violence.
Later, police carry the suspect go hospital under security after he sustain injuries during the incident.
Some residents dey suspect say the boy dey abuse dr¥gs, but police never confirm am, as dem say investigation still dey continue to know the full story behind the matter.

